Categories
Latest Post

Football reports in pidgin: Jamie vardy heaps praise on Ngolo Kante

Kante while on action with Chelsea

Leicester City striker, Jamie Vardy don come
outside dey confess say, me I never see player wey
be eruku like Ngolo Kante before. Walai, dat boy na
hire killer. whenever we dey train togeda for
Leicester then, na so e dey chance us upandan dey
collect ball for our leg like say we be small pikin.
And once him hold dat ball, even superman no fit
collect am back. In fact, sometimes I dey suspect
say him dey use play play take give us the ball
back so dat him go chance us again collect am
back. Walai the guy dey use us play like cat wey
dey play with rat wey e wan kill. The one wey shock
me pass na the day wey Kante tell us say the way
body dey do am, e be am like say make him begin
jog from him house come training. Da tin be like to
jog from Oshodi to Okoko. Na so all of us knee
down begin beg am make e no try am. If to say we
no beg am like dat, e for do am. Dat guy na real
akpuruka.

Ngolo kante as Jamie vardy team mates

Kante na all Avengers Endgame men put together.
The guy fit to de smile with you with that him small
pikin smile ho de tell himsef, ‘you see diz ones, na
big babies all of them be. Just one gberaa now, all
of them go surrender the ball.”


My people, how una see dis kind confession wey
Vardy confess dis hot afternoon so?


Victor Aluede: “Kante Na wetin Igbo people dey call okala mmuo,
okala mmadu! (Half human, half spirit)
The guy get 7lungs and this earth now dey made up
of 30% water and land, 70%kante
Kante don run comot for stadium before go carry
ball wey Lukaku balloon go another town during
match.
Kante don jog from England enter Senegal during
match between Chelsea and Liverpool when Mane
foul am.Him been go warn Mane mama, still come
back, just on time to dispossess Salah”

You have that opportunity now to watch videos in
one of the fastest rising YouTube channel inNigeria – De Royalty


Click here to view some interesting videos and
get the chance to view interesting videos.

Victor Aluede G.y's avatar

By Victor Aluede G.y

Aluede G.y Victory is a history
enthusiast an a mediapreneur living in Aboru,
Lagos. He studied arts at skills click foundation, he is an alumni of Rehoboth college Aboru, Lagos.

Leave a comment

Design a site like this with WordPress.com
Get started